Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand.
But en papa and mama nor happy. So dem ask am, “Yu nor si any woman wey yu like for awa family or di whole Israel wey yu fit marry? Why e bi sey na Filistia woman yu won marry?” But Samson tell en papa, “Make una go marry am for mi, bikos e look like betta pesin to mi.”