God tell Moses, “Make yu nor fear am. I go make yu win en, all en pipol and en land. Make yu do to am wetin yu do King Sihon, di Amor king wey bin dey rule for Heshbon.”
Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una!
Make una dey strong and make una heart nor shake; make una nor fear dem at-all, bikos na di Oga una God dey go with una. E nor go leave or forget una.”
Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”