Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 7:12
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon pray, “Di Oga wey bi Israel pipol God; e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for eart! Yu do wetin Yu promise yor pipol kon show dem yor love, bikos dem obey Yu with dia whole heart.


“Oga God for heaven! Yu big well-well and wi dey fear Yu. God wey keep en promise with doz wey love and dey do wetin E kommand.


Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.


doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand!


and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!


God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”


Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”


I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey: “God! Yu get pawa well-well and wi dey honor Yu. Yu dey keep yor promise and Yu love pipol wey love and dey obey Yu.


Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


wey E promise awa grand-grand papa dem and E go show mesi to Abraham and en shidren forever.”


Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”


Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind,


but I go show my mesi thru di kovenant to doz wey choose, obey and keep my kommand.


So una must obey all dis kommand, law and rules wey I dey give una today.


So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ