11 So una must obey all dis kommand, law and rules wey I dey give una today.
“If una love mi, una go do wetin I tok.
Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.
Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.
So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!
But E nor dey waste time to ponish and distroy doz wey rijet am.
If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.
Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.