Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 6:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 6:5
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Solomon love God and e follow wetin en papa David, tok. But e still dey kill animal as ofrin for difren altar.


E nor get any king before or afta wey turn kom meet God like King Josaya wey use en whole heart take serve God, just as Moses Law tok.


Dem gri sey na only di Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem go serve with dia whole heart.


Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


So evribody wey put dia trust for God hand, make una nor fear, instead make una get strong mind!


“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.


Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind.


Make una love God una Oga God with all una heart, soul and all una pawa.’


To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”


Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”


Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.


Una must love di Oga wey bi una God kon obey evritin wey E tok. Dat is, en law, rules and kommand wey E give una.


Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind,


Doz profets wey dey si wetin go happen, make una nor listin to dem, bikos di Oga una God go dey test una, to know weda una love am with all una mind and heart.


Una must follow di Oga una God kon woship only en and una must follow en kommandment, obey, serve and always dey loyal to am.


and una dey obey all di kommand wey I dey give una today (wey bi to love di Oga una God and always do as E tok), dat time, make una add three towns join di first three.


Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.


If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.


Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”


Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.


But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.


But make una dey obey God kommand and laws wey en savant Moses tell una with kare; make una dey loyal to am kon serve am with all una heart and body!”


To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ