Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 6:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Make una make sure sey una dey obey dis kommand well kon keep all di laws wey E give una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 6:17
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey make wi obey and keep yor kommand well-well.


Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do.


So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.


So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.


Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.


God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”


As una still dey dis world, wi wont make una kontinue to love one anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom.


Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind,


Den Moses koll Israel pipol kon sey: “Make una listin well-well to all di law and rules wey I dey give una today, so dat una go learn and obey dem!


If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.


So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!


Den Moses and di eldas for Israel kommand di pipol sey: “Make una obey all di kommand wey I dey give una today.


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ