Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 5:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 God tok to us face-to-face for di mountin from inside fire.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 5:4
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.” Moses tell God wetin di pipol tok.


God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.


So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”


Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.


E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face.


Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin.


But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.


Any kountry don ever hear God vois dey tok to dem from inside fire as una hear kon survive to tell pipol about am?


E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.


God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ