Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 5:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 5:31
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una must always dey obey my rules, laws and di kommandment wey I rite for una. Una must nor woship anoda god.


Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”


Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.


“I give dem my kommand kon tell dem my laws wey dey give life to doz wey obey am.


“Make una remember to obey my savant, Moses Law and all di kommandments wey I gi-am for Mount Sinai sey make e tell Israel pipol.


Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.


Una must love di Oga wey bi una God kon obey evritin wey E tok. Dat is, en law, rules and kommand wey E give una.


Dis na di rules and laws wey una must obey, wen una don enter di land wey una grand-grand papa God, dey give una. As long as una dey alive, una must obey dem.


For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.


Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.


All dis na di law, rules and kommand wey Moses tell Israel pipol afta e don lead dem komot from Egypt


Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.


Den Moses koll Israel pipol kon sey: “Make una listin well-well to all di law and rules wey I dey give una today, so dat una go learn and obey dem!


“So make yu go tell dem, ‘Make dem go back to dia house!’


Dis na di kommandment, statutes and ordinances wey Oga God give mi make I tish una and una must obey and do dem for di land where una dey go.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ