Deutronomi 5:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
25 But naw, why wi go won die again? Bikos if di Oga awa God tok to us again, den wi go really die! If wi kontinue to dey hear awa Oga God vois, wi go die!
Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.
Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”
Bikos dis na wetin una ask di Oga una God by unasef wen una gada go meet am for Mount Sinai. Una sey, “God, make Yu nor let us hear yor vois again or si di big fire again, bikos wi go die.”
“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.
Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive.