God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”
Dis na di rules and laws wey una must obey, wen una don enter di land wey una grand-grand papa God, dey give una. As long as una dey alive, una must obey dem.
Make e always keep dat kopy with am evriday as long as e dey alive. Like dat, e go learn how to fear di Oga en God as e dey obey all di laws and kommand.
Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.