8 Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?
Yu kom down from heaven kon tok to dem for Mount Sinai; Yu give dem betta judgement, laws, korrect tishings and kommands.
Yor rules dey pafet and wi go fit trust dem.
Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.
All yor kommand na true and all yor laws go last forever.
But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.
Naw, I don know sey evritin get where dem fit do rish and evribody get where dem know rish, but nobody fit undastand yor kommandment finish.
Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.
Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
God wont make dem know how E dey judge thru en raitiousness and how E dey show am.
I rite many-many laws for di pipol, but dem dey rijet dem, bikos dem won follow strenj and yeye god.
E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message.
If una obey am, E go karry una high pass evry oda pipol wey E kreate. Den una go get praiz, honor and evribody go dey tok good about una. Una go bi holy pipol to di Oga una God, just as E promise.