Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.
But if una turn back from una sin kom meet mi and do wetin I kommand una, I go bring una kom di place wey I don choose sey una go for woship mi, even doh una skata for evriwhere for dis world.’
so Yu kon allow dia enemies win and rule dem. But wen dem koll Yu for help wen dem dey trobol, Yu ansa dem from heaven. Bikos of yor great mesi, Yu send leaders wey kom save dem from dia enemies.
God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”
where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do.
Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.
Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.
Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.
Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”