So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”
Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.
So, make una go meet God and una nor go die. If una nor go meet am, E go kom on-top una like fire. Di fire go burn Bethel pipol and nobody go fit kwensh am or save una.
Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.
Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.
So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.
“Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex.
Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,
bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.
But make una undastand today sey, di Oga una God wey dey waka for una front na fire wey dey burn anytin; E go win dem kon make dem bi like mumu for una front. Just as God tell una, na so una go kwik-kwik konker and distroy dem finish.