Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 4:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 4:2
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So evry generashon go get hope and trust God and dem nor go forget en great mirakles, but dem go obey en kommand.


Make yu nor add join God word, if not, E go curse and koll yu lie-lie pesin.


So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”


sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu.


I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen.


“Una hear sey, ‘Make una love una neighbour and hate una enemy.’


My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am.


Forty years afta Israel pipol don komot Egypt, for di first day for di elevent mont, Moses kon tell Israel pipol evritin wey God kommand am.


So all dis kommand wey I dey give una so, make una obey dem with kare. Make una nor add join or remove from dem.


May bi una get profet or doz wey dey si wetin go happen among una and dem kon show una signs and wonders,


Moses give us God kommand, di special place wey E keep for en pipol, Israel.


Na den God kommand mi sey, make I tish una dis rules and law, so dat una go obey dem for di land wey una won enter go stay.


If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.


Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.


If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.


So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!


Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.


Joshua read Moses kommand for all Israel pipol front, plus di wimen, shidren and strenjas wey dey stay with dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ