Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 4:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 I dey tok like dis, so dat una nor go make juju kon kause wahala for unasef. Dis mean sey weda di juju bi like man or woman,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 4:16
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon tell Moses, “Make yu kwik-kwik go down! Yor pipol wey yu take komot from Egypt don dey sin and rijet mi.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Na so too, karpenter dey measure wood kon draw as e wont make e bi, den e go karve am like human being and put am for en shrine.


So I kon go look. Dem draw snake with oda bad animals and all dia juju for di wall.


Make una nor woship juju or make juju with iron. Na mi bi di Oga una God.


God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.


God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”


So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make.


Make una nor ever build juju house kon woship dem, bikos di Oga una God nor like all dat kind tin.


‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”


So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.


Afta una don born shidren and grand-shidren and una don tey for di land well-well, if una spoil unasef kon make juju and do yeye tins wey go make una Oga God vex,


Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.


Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,


Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!”


Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ