14 Na den God kommand mi sey, make I tish una dis rules and law, so dat una go obey dem for di land wey una won enter go stay.
“Naw, dis na di laws wey yu go tell Israel pipol:
Naw, make una listin to all en kommand wey I dey give una today, so dat una go strong rish to kollect and enter di land wey una dey go so.
E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.
But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.
Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una.