Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 4:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 4:12
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.” Moses tell God wetin di pipol tok.


God tell Moses, “Make yu go tell Israel pipol: ‘Una don si by unasef sey, I dey tok to una from heaven.


Una go hear one vois dey tok from una back sey, “Na di korrect way bi dis, make una waka pass der,” weda una dey waka go rite or left.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


One vois dey kry sey, Prepare one road for di wildaness for God! Make una klear di road for di desert for awa God!


One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!” So I ask, “Wish message I go prish?” Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass; let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.


So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”


As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


Na dis John Profet Isaya tok about sey, “One pesin dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make God road strait.’ ”


So di same word wey bi di ten kommandment wey E tell mi for di mountin and from di fire wen una gada go meet am, God kon rite dem put for dis ones as E bin rite am for di first stones.


Una waka kom stand near di mountin as di smoke from di mountin dey shot enter sky, but di mountin dark, bikos of di tick kloud.


E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.


But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.


Any kountry don ever hear God vois dey tok to dem from inside fire as una hear kon survive to tell pipol about am?


E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.


God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.


God tok to us face-to-face for di mountin from inside fire.


God give mi two stones and all di kommandment wey E tell una from inside di fire wen una gada go meet am for di mountin, E use en own hand take rite dem put for di stones.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


trumpet kon dey make nois. Israel pipol hear God vois, so dem beg am make E stop,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ