11 Una waka kom stand near di mountin as di smoke from di mountin dey shot enter sky, but di mountin dark, bikos of di tick kloud.
E tear di sky open kon kom down with one black kloud for en leg.
Afta, fire kom out, but God nor still dey inside di fire too. Afta di fire, Elijah kon hear one small vois.
E kon hide ensef for darkness and na di strong dark kloud E take round ensef.
Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.
Den God tell Moses, “I go kom meet yu inside tick kloud, so dat di pipol go hear wen I dey tok to yu and dem go always bilive yu.” Moses tell God wetin di pipol tok.
Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin.
But wen una hear en vois from di tick darkness as di mountin dey katch fire, all di eldas and leaders for una tribes kom meet mi.