Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make una remember as e bi before, make una tink about di generashon wey don pass. Make una ask una papa and una eldas and dem go tell una evritin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us! Wi go dey free from trobol forever!”


My Oga God, I dey tink about yor laws wey dey since and dem dey konfort my soul.


My God, wi don hear am with awa own ear and awa grand-grand papa dem don tell us about evritin wey Yu do for dia time.


Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa.


En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?


E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel, wetin dem go do. E still kommand awa grand-grand papa sey make dem tish di laws to dia shidren,


Wen una shidren ask una sey, ‘Wetin dis ofrin mean?’


“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.


Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.


Den di pipol remember as e bi before; dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask, “Where di God wey save en pipol from di sea? Where di God wey give Moses en Spirit?


True-true, make una look as e bi before, from di time wey God kreate pipol for dis eart kon rish naw and una look from where di heaven start go rish di end, anytin wey dey great like dis don ever happen or sey pipol si am before?


Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.


Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ