Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
Dis na wetin God tok, “Na mi kreate and form una for una mama belle kon help una, so make una nor fear, bikos una bi my savant; di pipol wey I choose and love.
But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.