Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:4
66 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.


I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”


God go dey forever! Make wi praiz di Pesin wey dey defend mi! Make una tok how God wey save mi strong rish!


Israel God don tok, di Pesin wey dey protet Israel tell mi sey: ‘King wey dey rule well and fear God,


Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”


Na bikos Yu si as e dey faithful rish, naim make Yu make kovenant with am. Yu promise to gi-am Kanaan, Hit, Amor, Periz, Jebus and Girgash pipol land. Di land wey en shidren-shidren go stay and Yu keep yor promise, bikos Yu dey faithful.


“Men wey dey undastand, make una listin to mi! God Almighty go fit do wetin dey wrong?


Yu sey yu nor fit si God; but make yu dey patient, bikos yor matter dey en hand.


Nobody fit kommand God or akuiz am sey E do bad tin.


Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?


Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.


God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.


God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body.


Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.


Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.


God dey alive! So, make praiz bi my Rock own and I go bless my God wey save mi!


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


I don put my life for yor hand. So Oga God, make Yu diliver mi, bikos Yu bi God wey dey faithful.


Bikos God word na true and wi fit trust evritin wey E dey do.


Den dem remember sey na God bi dia rock; sey na di Most High God save dem.


Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.


Make Yu let wi yor savants si yor works again kon allow awa shidren si yor glory.


Dem go sey, “God dey judge well! Na-im bi awa Rock and E nor dey do bad tin!”


Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.


E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory.


Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.


God pass en front kon sey, “Na mi bi Oga God. I bi God wey get mesi and pity; I nor dey kwik vex; just as I big na so too my love big rish and I nor dey fail.


Bikos I know sey anytin wey God do, na final and e go dey forever; dem nor go fit add anytin join am or remove anytin from inside. God make evritin like dis, so dat pipol go fear am.


Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


Make wi always dey trust God and E go protet us forever.


Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’


Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol; E sidan for en throne and E dey ready to forgive una. True-true, God dey good and evribody wey get faith and dey wait am, go happy well-well.


Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin. Mi, wey bi God, don tok.”


But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.


Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?


But God still dey di town and E nor dey do bad at-all. E dey always judge matter well and E nor dey fail. Yet wiked pipol nor dey shame at-all.


So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


Di Papa nor dey judge anybody, but e don give en pikin pawa to judge evribody,


Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.


Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins.


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).


bread and milk. Dem drink from di spiritual Rock wey follow dem go and dat Rock, na Jesus Christ.


Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.


But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.


Dem don forget di Rock wey bi dia papa and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again.


So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


Na only one Pesin give di law and na-im bi judge. Na-im dey save and distroy. Yu wey dey judge yor neighbour, na who yu even tink sey yu bi?


God word sey, “Naw, I don lay one stone for Zion; di main stone wey I choose; no money fit buy am and anybody wey bilive am, nor go shame.”


Nobody dey holy like God! E nor get anybody wey strong like Yu! E nor get any rock wey bi like God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ