Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:30
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”


So, as day dey dark, dem kon go Siria sojas kamp, but wen dem rish der, dem nor si anybody,


Some of dis men wey kom from Gad tribe na senior offisa wey dey kommand tazon pipol, while di odas dey kommand hundred.


Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.


If God arrest and put pesin for prison or karry am go kourt, na who won stop am?


God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand.


Yu nor give mi to my enemies and Yu don put mi for where I go dey save.


Na one-one kobo Yu sell yor special pipol and Yu nor gain anytin from inside.


Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


God wey get pawa dey tell en pipol sey, “Wen una bi slave, dem nor pay any money take buy una, na so too, dem nor go pay anytin to take free una.


Five of una go fit win hundred pipol and hundred of una go win 10,000 pipol.


Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.


Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.


So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.


Nobody dey holy like God! E nor get anybody wey strong like Yu! E nor get any rock wey bi like God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ