Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’
“I dey hear one nois on-top di hill: Na Israel pipol dey kry and beg dia juju. True-true, dem dey stay inside sin and don forget di Oga wey bi dia God.
Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.
Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.
“But dem forget di Oga wey bi dia God, so E give dem to Sisera wey bi oga for Hazor sojas, den to Filistia pipol; Moab pipol king and dem kon fight and opress Israel pipol.