Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Instead make dem sakrifice give God, dem dey sakrifice give juju and gods wey dem nor know; new gods wey dem just si, even gods wey dia grand-grand papa dem nor know about.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:17
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”


So my pipol, make una nor fear or shake! Una know sey from biginnin kon rish naw, I always dey tok di tins wey go happen and una bi my witness. E get any oda god apart from mi? E nor get any oda god, wey get pawa. I neva si or hear about any one?


Di juju dey yuzles, so make dem distroy dem trowey and time dey kom wen God go ponish and distroy all of dem.


I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.


bikos dem sin kon make mi vex. Dem offa sakrifice kon dey serve oda gods wey dem or yu or dia grand-grand papa nor ever woship.


So make di pipol nor sin against God kon offa sakrifice give dia goat juju. Israel pipol must keep dis law forever.


Israel pipol, I nor ask una for sakrifice and ofrin for doz forty years wey I lead una pass desert.


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


make una nor do am or listin to dem. Make una nor sorry for dem or protet dem.


bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!


Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.


Di Spirit tok sey for di last days, some pipol go leave di faith kon dey bilive lie-lie spirits and follow wetin demons dey tish.


But di pipol wey dis tins nor kill, nor still gri turn from sin kom meet God wey go save dem. Dem kontinue to serve demon and juju wey dem make with gold, silva, bronze, stone and wood. Dis juju nor dey si, hear or waka.


Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ