Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.
E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.
Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.
No oda nashon don ever shange dia god, even wen dem know sey dia gods nor bi god at-all. But my pipol don shange mi God wey give dem honor, with gods wey nor go fit help dem.
Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”
Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.
I dey hear my pipol dey kry for evriwhere for di land sey, ‘God nor dey Zion? Abi Zion king nor dey der again?’ ” But God ansa, “Wetin make una go woship juju kon make mi vex?”
Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.
Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.
Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,
Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.