Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 E feed dem with milk from di animals and with di fats wey dey lamb body. E give dem betta ram and goat form Bashan, plus fine-fine food. Una don drink di wine wey sweet pass wey dem make from grape.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:14
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E take some cream, some milk and di meat kon set di food for di men front. For under di tree for der, Abraham kon serve dem by ensef and di men kon chop.


E tie en donkey put for di vine, di vine wey e choose. Na wine e take dey wosh en klot and na grape e take dey wosh en garment.


Dem know sey David and en men go dey hongry and wota don dey hongry dem since for di wildaness.


Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.


But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,


Dem nor go live to si di river wey get olive or di one wey milk and honey full.


My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.


E send peace kom una land kon make una chop betta food.


My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan. Dem gada won bite mi!


But I go give Israel pipol betta food chop; I go make una beleful with betta honey wey dey flow kom out from di rock.”


Na milk and honey e go dey chop and dis food go help am know how to rijet evil and choose wetin dey good.


dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.


Dem go chop sojas body kon drink ruler and leaders blood; all dis pipol go die like ram, sheep, goat or like big melu.


I draw dem near body with love and kindness. I remove dia heavy load from dia head kon bend down feed dem by mysef.


Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”


Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.


“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.


Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una,


Den, dem press di grapes for outside di town and blood rush kom out from di place where dem dey press dem. Di blood high rish five fit and e nearly rush rish two hundred mile.


Sisera ask am for wota, but e gi-am milk. E use fine bowl take bring di milk for am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ