Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 32:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 E allow dem travel pass di high place for di land kon chop from di plants wey dey di field. E use honey from di rock and olive oil from strong groun take kare for dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 32:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E make my foot dey save like deer kon keep mi save for di mountin.


Dem nor go live to si di river wey get olive or di one wey milk and honey full.


My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.


E make my leg strong for groun like deer own kon make mi fit stand on-top high mountins.


But I go give Israel pipol betta food chop; I go make una beleful with betta honey wey dey flow kom out from di rock.”


Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert; E tear rock open, Yes! E make wota flow kom out from di rock.


den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.” Na mi wey bi God tok all dis tins.


Yu get difren gold and silva and yu always dey wear klot wey dem make with betta linen and silk. Yu dey chop bread wey dem make with di best flower and yu get many honey and olive oil to drink. Yor beauti dey shine and yu bi kween.


Den, mi too go klap my hand and I nor go vex again. Mi, wey bi God, don tok.”


God wey get pawa dey tell dem. Israel enemies tok against dem sey, ‘Naw, dis old hill don turn awa own naw!’


But naw wen una enter betta land, una don dey okay; dey karry body up kon forget mi.


Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una,


Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.


Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”


Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon


Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey;


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ