Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 30:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di Oga una God go take una enter di land wey E give una grand-grand papa, so dat e go bi una own too. E go make una prosper and many pass una grand-grand papa dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 30:5
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu dey good and na only good tins Yu dey do; so make Yu tish mi yor kommand!


Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’


bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”


Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”


I go make una pipol and animals dey plenty evriday. Una go many pass as una bi before and una shidren go plenty. I go let una stay here as una dey before kon make una betta pass before. Den una go know sey na mi bi God.


God wey get pawa sey, “I go allow Israel pipol ask mi for help and dem go plenty like sheep again.


Moses tell en wife broda Hobab wey en papa na Reuel wey kom from Midian sey, “Wi won start to travel go di place wey God don sey E go give us. E don promise to make Israel prosper, so make yu follow us and wi go trit yu well.”


Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.


E go love and bless una kon make una plenty and E go give una many shidren. E go bless evritin wey una plant and una animals. Wen una rish di land wey E promise sey E go give una grand-grand papa, una go harvest many korn, new wine, olive oil and many kattle, sheep and goats.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ