If una turn back kom meet God, doz wey karry una relashon go prison, go pity and free dem. Di Oga una God dey sorry for pipol and if una turn back kom meet am, E nor go rijet una.”
But if una turn back from una sin kom meet mi and do wetin I kommand una, I go bring una kom di place wey I don choose sey una go for woship mi, even doh una skata for evriwhere for dis world.’
Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one.
So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’
sey, God dey announce give di whole world naw sey: “Make una tell Jerusalem pipol sey God dey kom save dem and E dey kom with doz wey E don already save.”
Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.
bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!