Make una pray kon sey, ‘Awa Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us kon save us from dis nashons! Den wi go tank and praiz yor name wey dey holy.’
But if una turn back from una sin kom meet mi and do wetin I kommand una, I go bring una kom di place wey I don choose sey una go for woship mi, even doh una skata for evriwhere for dis world.’
Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one.
God sey, “I still get sometin wey I won tok about di wiked nashons wey surround Israel; di nashon wey distroy di land wey I give my pipol. I go rut dem from dia kountry like tree wey dem rut komot for groun, den I go save Judah pipol.
I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.
Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’
All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok, den una go-go tok about am for far land wey dey near di sea sey, “Just as shepad dey guide en sheep, na so too God wey skata en pipol, go gada and guide dem again.
Den my pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God. Dem go know, bikos I send dem go anoda land prisonas before, but naw, I don gada dem from all di kountries where I skata dem go before kon bring dem back to dia land and I nor forget or leave anybody for der.
Na so God go save all Israel pipol just as en word sey: “Di pesin wey go save Israel pipol go kom from Zion, den Jakob shidren nor go dey do bad tins again.
Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.