Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 3:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 “My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 3:24
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God! Yu dey great! Nobody bi like Yu. Na only Yu bi God. Wetin wi don hear, na true!


dem go kon woship and pray to Yu for dis temple.


kon pray: “Awa Oga wey bi Israel God, e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for dis eart! Yu dey show yor goodness to yor savant wey dey obey and respet Yu.


Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.


Who fit kount all di wonderful mirakles wey God don do? Who go fit praiz am rish?


God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz! Nobody fit measure as E big rish.


I go always dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do and I go tell evribody about di great tins wey Yu don do.


Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do; make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!


I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”


My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God?


My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


Fero ansa, “Na tumoro.” Den Moses sey, “E go bi as yu tok, so dat yu go know sey nobody bi like di Oga wey bi awa God.


Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?


I sey, “My God! Nobody bi like Yu. Yu dey mighty and yor name dey great with pawa.


Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”


Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’


Make una know for una mind sey, I nor dey tok to una shidren wey neva si as di Oga una God judgement bi or si as E big and strong rish.


Bikos I go tok about God name and how E dey strong!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ