Na God ensef dey lead us. En priest dey here won blow trumpet, so dat wi go kon fight una. Israel pipol, make una nor fight against una grand-grand papa God, bikos una nor go fit win.”
Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”
Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.
E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
God tell Moses, “Make yu nor fear am. I go make yu win en, all en pipol and en land. Make yu do to am wetin yu do King Sihon, di Amor king wey bin dey rule for Heshbon.”
Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una!