I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.
una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.
E go love and bless una kon make una plenty and E go give una many shidren. E go bless evritin wey una plant and una animals. Wen una rish di land wey E promise sey E go give una grand-grand papa, una go harvest many korn, new wine, olive oil and many kattle, sheep and goats.