5 Den for der, make una build altar for di Oga una God and make una nor use anytin take kut dem at-all.
Dem make di stones wey dem take build di temple, from where dem for kut dem, so no hammer, axe or any oda iron make sound for di main site.
And if una take stone build altar for mi, una must nor use stone wey dem kut, bikos if una kut di stones, una don spoil di altar bi dat.
Den Moses rite di word wey God tok. For early morning, e build altar for under di mountin kon arrange and stand twelf stones; one for each of di twelf tribes.
Una go build di Oga una God altar with betta stones; nor bi with ones wey dem kut, den una go offa burnt ofrin for der give di Oga una God.