Reuben wey bi Jakob first pikin, na en shidren-shidren bi dis. But bikos e sleep with en papa wife, di papa kon give en senior pozishon to Josef. So for dia family history, dem nor rite Reuben as di first-born.
Dem dey mash poor pipol head for san-san kon push doz wey nor get who go help dem komot for road. Papa and pikin dey sleep with di same woman and like dis, dem don spoil my name wey dey holy.