12 “Wen una cross Jordan River, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Josef and Benjamin tribe must stand on-top Mount Gerizim kon bless di pipol.
Den Leah sey, “God don give mi my reward, bikos I give my savant to my husband make e sleep with am.” So e koll am Issakar.
E kon koll am Josef wey mean, “Make God give mi anoda boy pikin.”
As Rashel dey breath like who won die, e kon koll di pikin Ben Oni. But Israel koll am Benjamin.
As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:
Dat day, Moses still tell dem:
And Reuben, Gad, Asher, Zebulun, Dan and Naftali tribe go stand on-top Mount Ebal kon curse any tribe wey nor follow God kommand.
Wen Jotam hear wetin happen, e go stand on-top Mount Gerizim kon shaut tell di pipol wey dey groun sey, “Shekem leaders, make una hear mi, so dat God go hear una!