9 Make una remember wetin di Oga una God do to Miriam as una dey kom out from Egypt.
Four men wey get diziz for body, sidan for di town gate. So dem tell demsef, “Wetin make us just sidan for here dey wait di time wey wi go die?
“Go kommand Israel pipol sey, ‘Dis na di pipol wey una go remove from di kamp: pipol wey get diziz for skin, doz wey dey discharge and evribody wey nor dey klean, bikos e go tosh dead body.
Make una remember wetin happen to Lot wife!
Dem rite dis tins wey happen to dem to tish us lesin and na ezample for doz wey go dey wen di world go end.
Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do,