Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 24:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 24:3
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


I drive Israel pipol, bikos of dia ashawo life, yet en sista, Judah, nor fear, but e kon join dey do ashawo too.


“Pipol dey sey, ‘Anybody wey drive en wife, must gi-am paper sey e nor won marry am again.’


Dem ansa, “Moses sey make man rite leta to divorce en wife.”


Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house.


Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man.


di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ