Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 24:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 24:1
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If di man kon marry anoda wife, e must kontinue to give en first wife food, klot and evritin wey e nid as wife.


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.


I drive Israel pipol, bikos of dia ashawo life, yet en sista, Judah, nor fear, but e kon join dey do ashawo too.


Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘If any man tink sey en wife nor dey faithful to am


But if di woman nor do am, den nor-tin go happen and e go fit born again.


Josef wey won marry am, na pesin wey dey fear God well-well and bikos e nor won disgrace am, e kon tink for en mind sey e nor go marry Mary again.


“Any man wey drive en wife, den marry anoda woman, don kommit adultery and di man wey marry woman wey leave en husband, don kommit adultery too.”


If man get two wife and e love won pass di oda, den di two wife born boy pikin, If di first-born na from di wife wey e nor love,


Dem go still tell am make e pay 100 silva to di woman papa, bikos na for publik e for curse di woman sey e nor bi virgin. Den di woman go still bi di man wife and e nor go fit sey make di woman pak komot from en house.


Di man wey rape di woman go pay 50 silva give di woman papa and di woman go bi en wife, bikos e don dis-virgin am. E nor go ever fit porshu di woman komot en house till e die.


Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man.


But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ