Egypt dey yor hand, so make yu do as yu like to yor papa and brodas. Dem fit stay for Goshen and if yu know any strong one among dem, yu fit gi-am my animals make e guide dem.”
Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God.
God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?” God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob