Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 22:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 If una build new house, make una build guide round di roof, so dat dem nor go sey una kill pesin in kase pesin fall from di top.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 22:8
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.


“If fire dey burn for pesin farm kon spread and distroy plant for anoda pesin farm, di pesin wey start di fire go pay evritin wey distroy.


Dis message na about di Vishon Valley: Wetin dey happen? Wetin make evribody dey klimb go on-top roof?


Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”


If I tell yu sey one wiked man go die and yu nor warn am make e shange from di bad tins wey e dey do, if e die, e go still die as sina and I go whole yu, bikos na yu make am die.


“If betta pesin kon start to do wiked tins and I kause wahala for am, e go die if yu nor warn am. E go die bikos of en sins; I nor go remember di good tins wey e do and I go whole yu for en deat.


Wetin I tell una for darkness, make una tok am for day time and wetin I tok for una ear, make una shaut am make pipol hear.


As dem nor si road pass go meet Jesus, bikos pipol plenty der, dem kon remove di zink on-top di house for where Jesus sidan, den dem kon small-small drop di bed wey di man liedan put till e rish groun.


For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray,


So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith.


Live yor life so dat yu nor go kause trobol for Jew or Greek pipol or for pipol wey dey God church.


Make una free di mama, but una fit take di shidren. Make una do like dis, so dat e go dey well with una and una go get long life.


Make una nor plant two difren seed for una vineyard; if not, all di fruit and di seed wey una plant, go skata.


so dat una go fit choose wetin betta pass and as una dey do so, una go dey ready for di day wen Christ go kom.


Make una nor put hand for wiked and evil tins.


Before dem kom down from di altar for di hill kon enter di town, Samuel follow Saul tok on-top di house.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ