7 Make una free di mama, but una fit take di shidren. Make una do like dis, so dat e go dey well with una and una go get long life.
If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life.
Una nor go kill melu or sheep and en small pikin togeda for di same day.
If una build new house, make una build guide round di roof, so dat dem nor go sey una kill pesin in kase pesin fall from di top.
If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.