5 Make woman nor wear klot wey bi man own and make man nor wear woman klot, bikos anybody wey dey do dis kind tin, dey make di Oga una God vex.
Anybody wey dey do dis kind tin, dey make God vex. Na bikos of dis tins wey di oda kountries do, na-im make God porshu dem komot from di land for una.
Wen una si una neighbour donkey or melu dey faint for road, make una nor trowey una eye or waka pass am; instead make una make sure sey una help di animal.
If una si bird house for tree or for groun and yong birds or eggs dey inside with dia mama for der, make una nor take di mama from en shidren.