Deutronomi 21:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
5 Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town.
Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.
Wen ever una kountry man kon ripot matter give una (weda e koncern pesin wey dem kill or about di law and kommandments), make una warn dem sey make dem nor sin against God. If una nor do like dat, God go vex for una and doz wey dey work with una, but if una obey am, una go dey free.
Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.
“Wen any kase dey kourt, na di priests go judge am akordin to my law. Dem go make sure sey dem kontinue di festival akordin to my rules and laws and dem must keep di Sabat Day holy.
For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today.
Dem go escort am go di valley wey dem neva plant or klear before and wey wota dey rush pass. Wen dem rish di valley, dem go break di melu neck for der.