Deutronomi 21:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
4 Dem go escort am go di valley wey dem neva plant or klear before and wey wota dey rush pass. Wen dem rish di valley, dem go break di melu neck for der.
Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town.
“So make una go make truck, plus two melu wey dem neva put wood cross dia head before. Make una karry dem for di truck kon drive dem with dia pikin go di yard.