For di sevent day, e go barber en hair again, en bear-bear, di hair wey dey en eye and all di hair wey dey en body. E go still wosh en klot kon baf, den e go dey klean.
“ ‘If anybody just die near am and e kon make ensef unklean since e don give ensef to God, den e must shave en hair for di day wen dem dey klean am. E must shave am for di sevent day, so dat e go dey klean.
And any woman wey dey pray or prish God message and e nor kover en head, dey disgrace en head, wey bi en husband; e for betta sey di woman shave en head.