6 Una fit buy food chop from dem and wota to drink from dem too.
Israel pipol kon sey, “Wi go stay for di main road and if any of us or awa animals drink yor wota, wi go pay for am, wi just won waka pass.”
Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye
Make una nor borda dem at-all, bikos I nor go give una any of dia land, bikos na di whole Mount Seir land I give Esau dia grand-grand papa.
“ ‘Di Oga wey bi una God don bless una for evritin wey una dey do. Evry step wey una take for di great wildaness, I dey with una. For dis forty years wey una dey dis wildaness, God dey with una and una get evritin.’ ”