Deutronomi 2:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
24 “So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am!
Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ”
Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.
“Na with my mighty pawa and great strent I take kreate di eart, di pipol and di animals wey dey inside and I don give dis pawa to pipol wey I like gi-am to.
Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’