Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.” David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”
Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.
For ezample, may bi pesin go forest with en neighbour go kut wood. Den one of dem kon karry di axe make e kut di tree and di axe head komot from di wood wey hold am kon kill di oda pesin. For dis matter, dat pesin wey kill di pesin fit run go one of dis towns and e go dey save.
Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin.
But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”