Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Deutronomi 18:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 And if one Levi pesin kom from any town for Israel kon sey e dey go where God don choose sey make dem woship am,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Deutronomi 18:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.


Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.


Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.


Pipol wey get pawa thru Yu, si as dia blessing big rish too. Dem like to always go yor temple!


Una must measure 1,000 yard from outside di wall for di town wey dey di east kon measure 1,000 yard from di sout-side and 1,000 yard from di west; di nort go bi 1,000 yard and all di towns go dey di middle. Dis aria must bi dia grassland for di town.


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


Una go only sakrifice am for di place wey God go choose from among una tribe. Na der una go for offa una burnt ofrin and do evritin wey I kommand una.


but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.


Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name.


e fit serve for der with God name, just like evry oda Levi wey bi priest wey dey serve God for der.


Dis na true word: If any man like to bi leader, na betta work e wont.


Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ